Many people don fall inside that trap, and many still never know how to commot from it because them dey fear to suffer…lol
Suffer good my beautiful people, my Mama suffer me before I get sense, without suffer no life
If i mess up then, my Mama go beat & insult me
Sameway if I mess up now, I go beat & insult by myself
Oyingbo people come our soil carry technology wey blind the eyes of our people, our mothers then threaten our father’s to follow oyingbo way or dem go leave, some of our lazy fore-fathers then concur and forget nature…chai oyingbo people
our fore-fathers forget their roots, their origin and began act like oyingbo, sotey to speak, we begin dey speak fúnnél like oyingbo people, abeg stay true to yourself, don’t forget your natural identity.
Always communicate with your inner-self, no allow big man blind you with money sotey you forget yourself, you forget all your plans in life, please don’t
Enjoyment nah temporary that recycled every now and then to pain. even for big man life pain plenty.
As poor man, if person tell you “no”, you go fit chest am but as a big man if person tell you “no” omoh e dey pain like kilode
Pain is not entirely bad if you know how to harness it power.
In business you will receive plenty “No” more than “Yes” you will receive many negative things more than positive things, just keep talking to your inner-self that’s our Creator force inside you to solve all your negatives and life will be a breeze.
Accept all the hard things your inner-self is telling you to do, embrace it, finetone it and in time that big man go dey patronize you.
Leave a Reply